Na wetin de sup, Jr Pope '' others?
Nigerian Observer  Apr 19, 2024     Visit Source  
   
 
 
 

By

April 19, 2024

I no de happi but l also need to trowey salute to all of una. Las las all of us go undastand de rison why. Make l ask una one question: na all of us wey see las nite see today so? Whosai! l no say de ansa go be NO! True true, if una follow me rison dis mata, una go no say, to fit close eye for nite sleep and cum fit still open am for morni na beta bonus. To kpai easi one kain and to also wake in de morni no easi as we all de take rison am.

Anyways, my pipo, if una see today and cum see tumoro join say una nor kpai or delete, make una tank baba God bcos no be moimoi to fit stand gidigba cum de alife. Na dis kain 6 oclock life make late Dele Giwa yan say for any person to close eyes sleep and cum fit see tumoro na bonus, and true true, na so dis life jus be. Odawise, how we wan take explain de kain kasala wey nack some of awa Nollywood actors and crew for Asaba?

Dis mata till today, l mean the boat kasala wey shele for Asaba, still be like person wey gazzle too much booze and cum begin sleep dat kain sleep wey de make person dream be laik malaria dream. If una rison de mata of Jr Pope plus de odas wey kpai for River Niger wia Mungo Park for delete, tears go run away from awa eyes. Nor be say na today River Niger begin to kpai pipo, but na de way dis deleting take de cum de wan confuse pipo mind and brain join.

According to pipo wey say dem no pipo wey no pipo wey see pipo wey cum hia wetin happen, dem say na strong mind naim make de mata shele. Dat is to say, strong mind to not wia dat blon-blo jacket wey dem de wia for on top canoe or flying boat on top river. Dem still cum say na de ones wey wia de blon-blo jacket no kpai as dem begin de float like feather on top water till rescue cum jam dem. Weda dis tori na true or na wetin nor be true no de my hand but inside baba God hand as na him alone no de tin wey dey on dat day.

De mata of dem deleting pain everi bodi for belle laik who carri de chew chloroquine laik chingum as e be say na human being dey for dis deleting mata. De tin must to pain person, but my quesion be say, why e be say na wen person or pipo kpai, awa brains de activate? Why e be say na for Naija, we de celebrate who don kpai more dan who de find food to chop? Why we nor de organise laik guguru and groundnut for inside paper? Na for dis kontri motor go jam person inside zebra crossing sign and police go arrest you for not dodging de car. Why awa mata be laik dat?

I also hia say, pipo para wen dem hia say de community pipo for wia de Nollywood pipo for kpai, bend eye yan say dem must to beri dem for near de river since dem kpai inside de river. Many pipo say, na de tradition be dat bcos na so dem don begin to do am from long long time ago. Again, if na de tradition why some pipo de yan pata on de mata? I also hia say, de community even allow say, if person wey river kpai him person perform de traditional rites for de river, dem fit cum carri de delete person go beria ground go beri. Again, if na no, or na true why pipo de shout for social media laik say person tif dia only fone?

My pipo, one tin l want make all of us learn from dis mata wey shele for Asaba as actors and crew de go do film for River Niger so be say, as actor or crew, de sign contract with who wan use you for film. Also ask plenti quesions about de film wey konsan your life, your health and many tins, e get why. Rememba say de actor tools wey him take de work na him bodi, so you as actor must to guard am wella. As for de crew, na ya brain plus ya bodi de owner of de film wan use. So, why you not go protect am de way lion de protect himsef?

Many pipo don yan tire for dis mata, but laik l first talk, de mata neva clear wella for man pikin to runam so dat make person no go run mouth laik vulcanizer machine wey nor fit pump tire. De tin l wan make all of us learn from dis mata as long as e don involve kpai-ing, deleting be say, na who hia de sound of gun naim bullet nor delete. So dia for, make you no allow any person to helep you use ya hand to take kpai yasef. Dis life no get duplicate as fotostarting machine neva dey to de fotostart awa life.

As dem yan for dis wahala wey hit Nollywood for head like stone so, dem confirm am say de pipo wey fall for inside River Niger don true true go dai kingdom, and for dat, make dia soul rest well in peace as we all pray say, make baba God helep the pipo dem lef behind to fit get strong mind to fit bear de loss. Afta all, las las dem say all of us go cum meet neva to kpai again. Make una find time to do one minute silence for dis Nollywood pipo wey don delete.

By

April 28, 2024

By

April 28, 2024

By

April 27, 2024

April 27, 2024 at 10:12 PM

March 12, 2024 at 09:21 AM

The Nigerian Observer is a daily newspaper published in Benin City, Edo State, Nigeria, since 1968 by the Bendel Newspapers Company Limited (BNCL) and is owned by the Edo State Government

Subscribe our newsletter for latest world news. Let''s stay updated!

© 2024 Nigerian Observer “ All Right Reserved.

 
 
Related Stories
 
 







   
   
 
 
 
 
Web Services Software Products Business Solutions Tech. Services Insight
   
               
© Plucom Technology Ltd.  Nigeria. All right reserved.